In WAEC examination , Akpos was asked to complete the following:
1) WAEC : He who fights
and run away?
AKPOS : E don surrender be
dat, na dear catch am
2) WAEC : A rolling stone?
AKPOS: No fit just dey roll,
... na person push am..
3) WAEC : He who lives in a
glass house?
AKPOS : Na rich politician
ego be…
4) WAEC : A stitch in time?
AKPOS : Dey prevent
further tear tear…
5) WAEC : Birds of the same
feathers
AKPOS : Na de same mama
born dem…
6) WAEC : One gud turn?
AKPOS : Na correct power
steering fit do am…
7) WAEC : A bird in hand?
AKPOS : Wetin e wan be
again? If no be barbeque….
Dem plenty for chicken
republic
8) WAEC : Half a loaf is
better than?
AKPOS : beans and gari,
soaking without sugar…
9) WAEC : A journey of a
thousand miles?
AKPOS : Na de person
wahala be dat,na why eno
enter car or aeroplane
jeje…
10) WAEC : He who laugh
last?
AKPOS: Get brain problem,
make dem examine am bcs
na beginning of madness
be dat…
11) WAEC : A patient dog?
AKPOS : Na hunger go kill
am…
12) WAEC : All work and no
play?
AKPOS : Na bank job be dat
bros…
13) WAEC : Once beaten?
AKPORS : Na revenge go
follow be dat…
14) WAEC : A fool at forty?
AKPOS : I never see for
Naija, our own dey start at
50…
0 comments:
Post a Comment